Ezenna who dey live in Aba
…love her eba
While others dey gym
That be when she finger her sim
Con dey talk plus person wey no fit give am tiii
As her bellɛ turn piii
II
Bot when she sees fine person wey grow
Na so her maut like bullet go go
Crying sotay dey ask God wetin she do
…wey she no fine too
She forget her gari
And de plenty food she chop wey she no feel sori
She forget say hard work dey for the fine bodi
Na so so she dey cry con wori
III
But dat tin go be only for night
Morning no go come meet her fright
She go wake up early morning
Come dey turn breakfast for supper
Na so her bodi come make big
Wey her mind no fit imsef dig
As she con dey grumble
Forgetting say beauty don dey eye
…wey sabi im heart
Amoafowaa Sefa Cecilia © July 20, 2021
Categories