People dey here dey talk
Talk talk be all una know
Person no fit tink for una presence
As rubbish con sweep from una brain
…con scatter minds
II
You dey here dey talk say Africa go unite
The same Africa where countries no fit fit for oda places
As jealous citizens con kill
…fry and burn persons wey dem say take thema market?
Make I hear word!
III
Una still dey talk?
Which Africa con feature for yua talk?
You make person laf for sadness
The same Africa where leaders dey make their stomachs cats
Make citizens rats
Con present country as beggars
…so them go get cuddle for white man trash
And con make us insults for awa own backyards?
Make I hear word!
IV
Who no like say Africa go come together?
But the greed wey greet us for morning
The corruption wey tire us for afternoon
The selfishness wey push us to evening
Plus the talk talk without work wey cover us for night
Be the tin which dey scatter awa dawn
Con finish awa hope
Africa unification go hard papa
So stop talking make I hear word
V
See, common nobodies dey bribe for post
See as drivers dey want to bribe koti
…rather than go court even if dem no do wrong
See, even those govment dey pay to work
Come use office dey dupe innocent person
See, Black man no dey buy black man tings
See as person dey go China con dey buy gari for import
Person go go America con dey import sweet drink for here
When awa fruits con dey spoil for awa farms
See, we dey hate say each oda go grow
But we dey push abrofo like them be gods
See talk talk be awa nonsense
Wey serious problems no get tongue im bed
So wetin you dey talk say Africa go unite?
Stop, make I hear word!
VI
If ground no flat for problems
The road people go take con unite go harrrd
…my sister
If Black no show respect to Black
The room we go sit come talk no go fit us, brother
If awa leaders no see sense
…con grab awa chances take push us grow
And hearts no forgive eachother for wickedness
…wey pass from country wey dey Africa im stomach
We all fit jump to heaven
…go call God to intervene
But even God im talk no go fit do notin
Abeg, people, stop talk talk make I see sontin
Africa no fit unite wit words alone
Amoafowaa Sefa Cecilia © May 7, 2021
Categories