Categories
POETRY

I NO GO SAY AM O

IMG-20150511-WA0008

I wan say am

But ibi like say I can’t

Why?

Last time, when person opened im mouth

And said those people be fools, dem cut im head like chicken

Another person too go say that them be like dogs

And cats and lions

He too, im body turn meat wey was shared for dogs on road

One woman said them be vampires

Na soso blood dem want suck

No eye saw that woman again

All of them said she be witch who vanished

Soso fight dem fight but dem no want mouths to yap

Dem dey want mouths talk say nyash be face

See as dem dey kill each other sake of meat?

Tomorrow, dem go fight over where air blow to

Because me I know say sake of woman, many men don die

Them lose thema lives like fowls in Christmas

Many say hush hush dat them no dey understand nothing

But me, I fear o

I no want trouble so I no go say am

Na thinking I wan think about me o

Shebi each one for himself?

Amoafowaa Sefa Cecilia (c) 2015

amoafowaa's avatar

By amoafowaa

Just a simple Ghanaian trying to find the best in our society. I may be fun, I may be interesting, I may be funny, I may even be foolish or intelligent, but it is all based on the mood in which you find yourself. I believe our minds make us who we are. Know that, pain, no matter its 'unbearability', is transient. Unburden or delight yourself for a while in my writings please. And all corrections, advice and opinions are welcome. Know that you are the king, queen or royal on this blog. :)

4 replies on “I NO GO SAY AM O”

Leave a comment