Oshobo
You pull yua mout like train dey complain about povaty?
Make you sit like vuvu
Complain sotaay
Yua shoddy no go fall from that shoulder
…come dey follow you
II
Oshogbo
You dey der dey complain about tummy?
You continue eating nyafunyafu like mumu
You tink say the stomach go fear food
…cum dey flat for your front?
III
Oshogbo
Bath o, bath!
Scent wey get fist cum dey box wanna nose
…like Azumah
No go make work find you for yua home
IV
Oshogbo
Yua teet no go grow gogomi
…come dey feed your nyash
If brush no dey
…chewing stick climb tree?
V
Oshogbo
Me I no go pity you
Ibee like say you turn wizard
…come dey do una own sef
Povaty bi one tin
Self care be anoda
Complain go follow failure cum dey fail you
Amoafowaa Sefa Cecilia
ยฉ February 18, 2021
Categories
2 replies on “OSHOGBO”
‘…failure cum dey fail you’. Hahaha…
I love this deviation.
LikeLiked by 1 person
๐๐๐๐
LikeLike