Hello, hello!
Make we talk about dat fellow
That fellow wey no wan mellow
For im boss. Just leaf am, im color go be yellow
When them im follow
And make shadow
Hello, hello! You dey there?
Ahaaa! But she day complain sotee say im life no be fair
Eno be madness dey worry de person wey want share
Power plus im master square?
As for me, I go be like de mare
Na so I go get fair share
Of de money wey dem de stare
Make u no walk plus am
She go make una life awam
You no go get notin. Bam!
Edey like me, even I better pass am
So im dey use me some
To see the god some
I beg make u cum
As we dey now, ibe like we dey walka on some small stick on a dam
Abeg make we sacrifice our pride o and farm
You too dey hear?
Ibe the big men wey select us wey de people dey bear
Na if I wan pass dose persons, ino go be queer?
You for pass dem persons always saying yes sa massa, na so, in fear
So dem no go snare
Persons wey go fit kill and cheat anytime with flair
I no want fight o, ibe money wey I dey care
About. Chae! Make we pause here today, hear?
Amoafowaa Sefa Cecila (c) 2013.